Skip go main kontent

Non-fungibol tokens(NFT)

  • Na one way wey yu fit reprisent anytin wey dey unik as Ethereum-based asset.
  • NFTs dey give more pawa to kontent kreators pass any taim bifor.
  • Na smart contracts on top of Ethereum blockchain dey give di pawa.

Wetin bi NFTs?

NFTs na tokens wey dey unik on dia own. Ish NFT get im own difren propatis (non-fungibol) and e dey very skarse. Dis dey diferen from tokens wey bi like abi oda tokens wey base on Ethereum laik USDC wia efri token dey identical and get di same propatis ('fungible'). Yu nor mind wich spesifik dollar bill (abi ETH) yu get for yor wallet, bikos dem look di same and get di same worth. Anyhow e bi, yudey kare for wich spesifik NFT yu get, bikos dem bi pesina propatis wey make dem fit stand out from odas (''non-fungibol).

Di unikness wey ish NFT karry dey enabol make dem fit get yus token do tins like art, kollectibols, abi even real estate, wia one spesifik unik NFT reprisent some spesifik unik real world abi digital item. Ownaship of one asset dey yu fit verify in di publik on Ethereum .

Intanet wit difren assets

NFTs and Ethereum dey solve some palava wey dey di intanet today. As efritin bikom more digital, e dey impotant to replikate di propatis of fisika items laik skarsity, unikness, and pruf of ownaship in a way wey no central organizashon dey kontrol. For eksampol, wit NFTs, yu fit own one musik mp3 file for all apps wey dey on top Ethereum and nor dey tied to one kompany's spesifik musik app laik Spotify abi Apple Musik. Yu fit own one soshia media handol wey yu fit sell abi swap, but a platfom provida nor fit take am away from yu.

Si as intanet of NFTs dey compia to di intanet wey plenti of us dey yus today...

One kain komparison

One NFT intanetDi intanet tuday
Na yu get yor assests! Na only yu fit sell am abi swap am.Yu rent one asset from some organizashon dem and dem fit kollet am from yu.
NFTs dey digitally unik, no two NFTs dey di same.Yu nor fit seperate a kopy from di original.
Dem store ownaship of NFT on di blockchain for anyone to verify am for publik.Na institushons dey kontrol di access to ownaship rekod of digital items - and yu go biliv wetin dem tok.
NFTs na wey dey on top Ethereum. Dis mean sey dem fit yus dem for oda smart contracts and aplikashon wey dey ontop Ethereum!Kompanis wey get digital items dey always nid dem own "walled garden" infrastrukshure.
Pipol wey dey kreate kontent fit sell dem work anywia and fit enta one global market.get access to di global market.Kreators dey dipend on di infrastructure and distribushon wey di platfoms wey dem yus provide for dem. Dis dey onda tams of yus and geografika restrikshons.
Pipol wey dey kreate NFT fit retain ownaship rites ova them own work and program royaltis direct into di NTF kontract.Platfoms, laik savis wey dey stream musik, dey retain di plenti profits from sales.

Wetin dem dey yus NFT for?

Dem dey yus NFTs for many tins, wey inklude:

  • pruf say yu go event
  • proof say pesin finish a kourse
  • ownabol items for games
  • art wey dey digital
  • tokenizin asset wey dey real-world
  • pruf of identity for online
  • e dey kontrol asess to kontent
  • e good for ticketin
  • e dey for desentralize intanet domain names
  • kollateral inside

E fit bi say yu bi artist wey wont shia dem work wey dey yus NFTs, witout luzin kontrol and sakrifisin yor profits to intamediaris. Yu fit kreate new kontrat and spesify di nomba of NFTs, dem propatis, and one link to some spesifik artwork. As di artist, yu fit program am inside di smart kontract di royaltis wey dem suppose pay yu (e.g. transfa 5% of hau much dem sell NFT to di pesin wey get di kontract efri taim wey dem sell yor NFT). Yu fit also always pruf say yu don kreate di NFT bikos yu go own di wey deploy di kontract. Pipol wey dey buy fit pruf sey dem own one orijina NFT from yor koleshon bikos dem wallet dey konet wit one token inside yor smart kontract. Dem fit yus am akross di Ethereum ekosystem, konfidnet in im authentisity.

Eksplore, buy abi kreate yor own NFT art/kolectibols...
Make yu eksplore NFT art

Abi konsida one ticket for one sport event. Just like pesin wey dey organise one event fit shuse many tickets to sell, pesin wey kreate NFT fit deside hau many replikate dey. Somtaims dis dey resembol am, like 5000 General Admishon tikets. Somtaims dem dey mint plenti wey bi di same, but ish one difren smoll, like one ticket wit one seat wey dem assign. Pipol fit buy and sell dem peer-to-peer witout paying ticket handlas and di pesin wey buy go always get asurans for di ticket authentisity as dem dey shek di kontract address.

For ethereum.org, dem dey yus NFTs to show sey pipol don kontribute wella to awa Github repository (dem don program di website, write abi modify artikol...), don translate awa kontent, abi attend awa komunity kolls, and wi even get awa own NFT domain name. If yu kontribute to ethereum.org, yu fit klaim one NFT. Some crypto meetups don yus POAPs as tickets. More to dey kontribute.

ethereum.org POAP

Dis website get anoda domain name wey NFTs pawa, ethereum.eth. Na one domain name system (DNS) provida dey sentraly manaj awa.orgaddress, but ethereum.eth dey regista on Ethereum via di Ethereum Name Savis (ENS). And na wi dey own and dey manaj am. Make yu shek awa ENS rekod(opens in a new tab)

More on ENS(opens in a new tab)

Hau NFTs dey work?

Dem kreate NFTs, laik any dijita items on di Ethereum blockchain, thru one speshia komputa program wey dey on top Ethereum wey dem dey koll "smart kontract" Dis kontracts dey follow some rules, laik abi standards, wey ditamin wetin di kontract fit do.

Di NFT smart kontract fit do some main tins:

  • Kreate NFTs: Im fit make new NFTs.
  • Make yu assign ownaship Im dey monitor who own wich NFT by linking dem to spesifik Ethereum address.
  • Make yu give ish NFT one identity: Ish NFT get numba wey dey make am dey unik. In adishon, some informashon always dey (metadata) wey attash to am, as im dey diskribe wetin di NFT reprisent.

Wen someone "kreate" abi "mint" one NFT, dem dey tell smart kontract to give dem ownaship of one patikular NFT. Dis informashon dey store sikure and for publik in di blockchain.

Furthermore, pesin wey kretae di kontract fit add extra rules. Dem fit limit hau many of some NFT wi fit make abi deside sey dem suppose get smoll royalty fee weneva di NFT dey shanj hands.

NFT sekurity

Di sekurity for Ethereum's dey kome from . Di system dey design to ekonomikally komot bad akshon, e dey make Ethereum tamper-proof. Dis na wetin dey make NFTs possibol. Wons wi don finalize di wey dey kontain yor NFT im go kost one attaka plenti of ETH to shanj am. Anyone wey dey run Ethereum softwia go fit sabi dishonest wey dey attak NFT immediately, and di bad aktor go penalize and eject dem ekonomikaly.

Sekurity issues wey dey rilate to NFTs dey often rilate to phishin skams, vulnerabilitis wey dey smart kontracts abi user errors (such as private key to dey ekspose), as e dey make good wallet sekurity kritical for NFT ownas.

More on sikurity

Further reading

Oda risorsis

Test your Ethereum knowledge

Shey dis page dey helep?