Skip go main kontent
Show of one city for fushure, wey dey reprisent ecosystem for Ethereum.
Ethereum

Welkom to Ethereum

Ethereum na di komunity-run technology wey dey ginga cryptocurrency ether (ETH) and plenti aplikashons wey dem disentralize.

Play with Ethereum

Oya start

ethereum.org na yor portal wey dey take yu enta Ethereum world. Di tech dey new and dey always show - im dey helep show pipol way. Dis na wetin we rekomend make yu do if yu wont enta am.
Wetin dey show pesin wey dey work for komputa.

What is Ethereum?

Ethereum na di technology wey bi haus for digital money, world payments, and aplikashons. Di komunity don build betta digital ekonomy, bold new ways for kreator to dey make money online, and many more. Im open to evryone, anywia yu dey for di world - all yu nid na intanet.
What is Ethereum?Plenti on digital money
Wi dey show pesin wey dey look inside bazaar, wey supose reprisent Ethereum.

Finanshia system wey dey okay

Today, plenti pipol nor fit open bank akants, dem don blok oda pipol money. Ethereum desentralize finans (DeFi) system neva sleep abi do pashia. Wit one intanet koneshon, yu fit send, kollet, borrow, chop betta interest, and even dey kollet money from anywia for dis life.
Wi dey show hands wey dey give ETH symbol.

Internet with different assets

Ethereum nor just dey for digital money oo. Yu fit trade anytin wey yu get if yu put am as (NFTs). Yu fit turn yor work to tokens and get money wen dem resell am. Difrent tins dey hapun all di taim.
Eth logo wey wi dey yus hologram show.

Intanet wey open for evrybody

Today, wi gain asess to 'fri' intanet savis if wi surenda awa pesina data. Ethereum savis dey open to evrybody - yu just nid one wallet. Dis na fri and izy way to set up, wey yu dey kontrol, and dey work witout any pesina info.
Wi dey show one fushure komputa set up, wey Ethereum krystals dey run.
Code eksampols
Yor own bank
Yu fit build bank wey dey work wit di logik wey yu don program already.
Yor own kurrency
Yu fit kreat tokens wey yu fit transfa and dey yus akross aplikashons.
Javascript Ethereum wallet
Yu fit yus di languaj wey exist to mix wit Ethereum and oda aplikashons.
Open, pamishonless DNS
You fit imajin di savis wey dey exist again as disentralize, open aplikashons.

One new frontia for divelopment

Ethereum and im apps dey klear and dey open sorse. Yu fit fork code and yus di funshonality wey odas don already build. If yu nor wont learn new language yu fit just mix wit open sorse code wit Javascript and oda languages wey dey exist.

Ethereum today

Di latest netwok statistics

Total ETH staked

Di komplit amount of Ethereum wey dem dey stake nau and di one wey dey sikure di netwok.

31.29M

Today transashon

Di numba of transashons wey dem don susessfully prosess for di netwok for di past 24 hours.

Value wey dem lock inside DeFi (USD)

Di money for disentralized finans (Defi) aplikashons, di Ethereum digital ekonomy.

US$125.2B

Nodes

Na plenti Voluntias around di world dey run Ethereum, wi dem dey koll nodes.


Waka enta di ethereum.org komunity

Abeg join us wi don get almost 40 000 membas for awa Discord serva(opens in a new tab).

Make yu show fase for awa evry month komunity kolls for betta update for Ethereum.org divelopment and impotant ecosystem news. Get di shans to ask kweshon, shia idias, and provide feedbak - im bi di pafet oportunity to bi pat of di Ethereum komunity wey dey grow.

☎️ Ethereum.org Community Call - March 2024

28 Mach 2024 fọ 16:00

(UTC)

Join Discord(opens in a new tab)Make yu add am to kalenda(opens in a new tab)

Kolls wey dey kome


4 Épr 2024

Kolls wey don pass


Find ethereum.org