Skip go main kontent

Gas fee

Netwok fee

Netwok fees on Ethereum na im dem dey koll gas.
Gas na di fuel wey dey make Ethereum wok.

Hero header image

Summary

  • Every transacshon on Ethereum nid one smoll type of payment to process am
  • Na dis fees dem dey koll 'gas' fee
  • Gas fees dey shanj base on netwok palava

Wetin bi gas fees?

Make yu tink of Ethereum as one big komputa netwok wia pipol fit dey do tins like send mesaj abi dey run programs. Just like for real world, dis dem wok nid enagi to do dem.

For Ethereum, ish komputashonal akshon get one set "gas" price. Yor gas fees na di total cost for di akshon for yor transakshon. Wen you send one transakshon abi run one smart kontract, yu go pay gas fees to process am.

A robot

How I go pay smoll gas?

As pesin nor fit afoid higher fees for Ethereum sometaims, e get some ways yu fit yus ridus di cost:

Make yu taim yor transakshons

Just like pesin wey dey travel off-peak nor get plenti pipol and nor too cost, Ethereum dey generally cheap to wella wen pipol for North America dey sleep.

Make yu wait for gas to go down

Gas price dey go upandan for every twelve seconds base on e dey busy rish for Ethereum. Wen gas prices dey high, to dey wait just for few minute bifor makin transakshon fit make yu si big drop in wetin yu pay.

Make yu yus Layer 2

Dem build Ethereum ontop Layer-2 chains, e dey give very smoll fees and dey handol more transakshons. Dem be gud shoise to save on fees for transakshons wey nor nid to hapun on di main Ethereum netwok.

Make yu try layer 2

Wetin dey kause high gas fees?

Weneva di kalkulashon (gas) for Ethereum dey pass one kain level, gas fees go start to dey rise. Di more di gas go pass dis level, de faster gas fees dey inkrease.

Popular dapps abi NFTs fit make fees dey higher, everytaim inkrease for trade on DEXs, abi one kain plenti numba of pipol wey dey yus am for di peak times.

Pipol wey divelop Ethereum supose take kia to make dia smart contracts wok wella bifor dem bring am komot. If plenti pipol de yus smart contract wey dem nor write wella, im go chop more gas and im fit kause netwok palava kwik-kwik.

Shey yu want enta wella? Make yu shek di divelopa dokument.

Atak of di Cryptokitties

For november 2017, dem launch di pupola CryptoKitties project. Di kain pipol wey like am make am get plenti netwok palava and make am get high gas fees. Di shalenj wey CryptoKitties kause speed am up to dey find solushon to make Ethereum grow wella.

Why wi nid gas?

Gas na one ogbonge element to dey yus kip Ethereum and dey process transakshons. Gas dey helep for many ways:

Gas dey kip Ethereum safe as im dey prevent wayo pipol from enterin di netwok wella wit dem korup aktivitis.

Bikos kalkulashon dey make gas cost plenti, and dey make Ethereum get transakshons wey dey too high, weda by asident abi by wayo, e nor dey enkoraj finanshialy.

One hard-limit for di amount to dey kalkulate dat fit hapun at any taim dey prevent pipol to dey ova yus Ethereum, as im dey helep to make sure sey pipol fit yus di netwok always.

How dem dey kalkulate gas?

Waya Pass

Di total gas fee yu dey pay is made up of few pats:

  • Base fee: one fee set by di netwok wey pipol fit yus pay for transakshon
  • Priority fee: one opshon tip to dey incentiviz node operators to add yor transakshon
  • Units of gas dem don yus*: shey yu rimemba wi tok sey gas reprisent komputashon? Plenti akshons wey hard, like to dey meet wit one smart contract, dey yus more gas pass simpol ones, like to dey send one transakshon.
    • * Make yu si Figor 1 to si how much gas difrent types of transakshon dey yus

Di formula wen kalkulatin one gas fee na units for gas yuse * (base fee + priority fee). All wallets go kalkulate gas yus and show am for inside diret way.

Figor 1: Gas yus by transakshon type
Transakshon typeUnits of gas yus
To dey send ETH21,000
To dey send ERC-20 tokens65,000
To dey transfer and NFT84,904
To dey swap on Uniswap184,523

Kweshon wey pipol dey ask

Shey dis page dey helep?