Disentralized aplikashons
Ethereum-powered tools and sarvis
Dapps na growing movement of aplikashons wey dey yus Ethereum to distub biznes models abi invent new ones.
Make yu start
To try one dapp, yu go nid one and some ETH. Wallet go alow yu konet, abi log in. And yu go nid ETH to pay any .
Im dey izy for pesin wey just dey start
E get some dapps wey good for pipol wey just start. Make yu shek more dapps bilow.
Uniswap
Swap yor tokens wit ease. Na komunity padi wey go fit alow yu trade tokens wit pipol all ova di network.
OpenSea
Yu fit buy, sell, diskova, and trade goods wey get limited edishons.
Gods Unchained
Stratejik kard game wey dem fit trade. Yu fit chop kards by playin di game, and yu fit sell dis kards for real moni.
Ethereum Name Service
User-friendly names wey dey for Ethereum deu address and desentralize sites.
Search dapps
Plenti dapps still dey experimental as dem dey test di possibilitis wey desentralized networks fit offa. But some dapps don already make am for arias like teknology, finans, gaming, and colectibols.
Shuse kategory
Decentralized finans
These na aplikashons wey dey fokus on buildin out finanshial sarvis as yu dey yus cryptocurrencies. Dem dey offa d likes of lending, borrowing, earning interest, and private payments - yu nor rikwaya pesina data.
Always do yor own risearsh
Ethereum na new teknologi and aplikashons wey new pass. Bifor yu deposit any big kwontity of moni, make sure yu undastand di risks.Lending and borrowing
- GoAaveLend yor tokens make yu earn interest and withdraw any taim.
- GoCompoundLend yor tokens make yu earn interest and withdraw any taim.
- GoSummer.fiYu fit trade, borow, and save wit Dai, one Ethereum stabolcoin.
- GoPWNIzy loans wey dey backed by any token abi NFTs on Ethereum.
- GoYearnYearn Finans na yield aggregator. E dey give individuals, DAOs and oda protokol a way to deposit digital assets and risiv yield.
- GoConvexCovex dey alow Curve liquidity providas to earn tradin fees and klaim boosted CRV witout to dey lock dem CRV.
Eshanjis
- GoUniswapYu fit to swap tokens abi make you provide tokens for % benefits.
- GoLoopringPeer-to-peer tradin platfom wey get speed.
- GoBalancerBalansa na one tin wey dem don program to dey manaj walet balans automatikaly and wi fit yus am trade too.
- GoCurveCurve na dex wey fokus on stabolcoins
- GoDODODODO na on-chain liquidity provida, wey dipend on Proactive Market Maker algorithm (PMM)
Bridges
- GoRubicKross-Chain tech aggregator for users and dApps dem.
Investment monie
- GoPoolTogetherLottery wey yu nor fit luz. prizes dey evry week.
- GoIndex CoopNa one crypto index fund wey go give yor portfolio exposure to top DeFi tokens.
- GoYearnYearn Finans na yield aggregator. E dey give individuals, DAOs and oda protokol a way to deposit digital assets and risiv yield.
- GoConvexCovex dey alow Curve liquidity providas to earn tradin fees and klaim boosted CRV witout to dey lock dem CRV.
Portfolio management
- GoZapperYu fit to dey si yor portfolio and yus plenti of Defi products ontop one interface.
- GoZerionManage yor portfolio and simply evaluate evry singol DeFi asset wey dey di market.
- GoRotkiOpen source portfolio tracking, analytics, accounting and tax reporting tool wey dey respect yor privacy.
- GoKrystalA one-stop platfom tu asess all yor favorite DeFi savis.
Crowdfunding
- GoGitcoin GrantsCrowdfundin for Ethereum komunity projects wit amplified kontribushons
Derivatives
- GoSynthetixSynthetix na protokol wey dey for giving and trading assets wey dey synthetik
Yu wan browse more apps?
Di magik bihind decentralize finans
Wetin dey about Ethereum wey dey alow decentralize finans aplikashons to thrive?
Asess dey Open
Finanshia sarvis wey dey run on Ethereum nor get sign up rikwayament. If yu get funds and intanet koneshon, yu dey good to go.
Ekonomy wit new token
E get whole world of tokens wey yu fit play wit for dis finanshial products. Pipol dey build new tokens on top of Ethereum all di taim.
Stabolcoins
Teams don build - na less volatile cryptocurrency. E dey alow yu try and yus crypto witout di risk and wahala.
Intakoneted finanshial sarvis
Finanshial produts wey dey di Ethereum space dey all modular and kompatibol wit one anoda. New konfigurashons wey dey dis modules dey hit di market all di taim, e dey inkrease wetin yu fit do wit yor crypto.
Di magik wey dey bihind dapps
Dapps fit dey like regular apps. But bihind wetin yu nor dey si dem get some speshial kwolitis bikos dem inherit all of Ethereum's supapawas. Si wetin dey make dapps difren from apps.
Wetin dey makes Ethereum great?Ownas nor dey
Wons dem deploy dapp kode to Ethereum, dem nor fit rimuv am again. Anybody fit yus di features of di dapp. Even if di team wey kreate di dapp skatta, yu still fit yus am. Wons im dey on Ethereum, im nor dey komot.
Free from censorship
Payments wey dey built-in
Plug and play
One koded login
Backed by cryptography
Down taim nor dey
How dapps dey work
Dapps get dem backend kode (smart kontracts) wey dey run on one disentralized netwok and nor bi one sentralized server. Dem yus di Ethereum for data storage and smart kontracts for dem app logik.
One smart contract na like set of rules wey dey live on-chain for all tu see and run exactly akordin to doz rules. Imagin one vending machine: if yu supply am wit enuf funds and di rite seleshon, yu go get di item yu wont. And like vending machines, smart contracts fit hold funds like yor Ethereum akant. Dis dey alow kode to mediate agriments and transakshon.
Wons dapps don dey for di Ethereum network yu nor fit shange dem. Dapps fit dey decentralized bikos na logik dey control wey dem write into di contract, nor bi individual abi kompany.