Skip go main kontent
Change page

Arranging Smart Kontrakts

Yu nid to diploy yor smart kontract for am to dey afailabol to users of one Ethereum netwok.

To deply one smart kontract, yu fit send one Ethereum trabsakshon wey dey kontain di code of di smart kontract wey dem gada witout showin any pesin wey go risiv am.

Prerequisites

Yu suppose ondastand Ethereum netwoks, transakshons and di strukshure of di smart kontract bifor dem run di smart kontracts.

To dey run one kontract dey also kost ether (ETH) bikos dem don store am inside di blockchain, so yu suppose sabi gas and fees on top Ethereum.

Las las, yu go nid gada yor kontract bifor yu run am, so make sure sey yu don read about hau to dey gada smart kontracts.

Hau to deploy one smart kontract

Wetin yu go nid

  • Di kontract's bytecode– dem dey generate dis thru kompilashon
  • ETH for gas - yu go set yor gas linit laik oda transakshons so make yu dey awia sey kontract deployment nid plenti gas pass one simpol ETH transfa
  • one deployment skript abi plugin
  • Access to one Ethereum node, weda tu dey run yor own, dey konet to publik node, abi thru one API key as yu dey yus one node savis

Steps to dey deploy one smart kontract

Di spesifik steps wey involve go dipend on di divelopment framewok wi tok about. For eksampol, yu fit shek out Hardhat dokumentashon to dey yus deploy yor kontracts(opens in a new tab) abi Foundry dokumentashon to dey yus deploy and verify one smart kontract(opens in a new tab). Wons dem don deploy am, yor kontract go get Ethereum address laik oda akants and yu verify am as yu dey yus sorse code verifikashon tools.

Remix - Remix IDE dey divelop, deploy and administa smart kontracts for Ethereum laik blockchains

Tenderly - Web3 divelopment platfom wey dey provide debuggin, observability, and infrastrukshure buildin blocks to dey divelop, test, monitor, and operate smart kontracts

Hardhat - One divelopment environment to dey gada, deploy, test, and debug yor Ethereum softwia

thirdweb - Im dey deploy any kontract izy to any EVEM kompatibol chain, as im dey yus one singol komand

Crossmint - Enterprise web3 divelopment platfom wey dey on grade to dey deploy smart kontracts, enabol kredit-kard and kross chain payments, and dey yus APIs to kreate, distribute, sell, store, and edit NFTs.

  • To dey deploy yor first smart kontract – One introdukshon to dey deploy yor first smart kontract on one Ethereum test netwok.
  • Hello World | smart kontract tutorial – One izy-to-follow tutorial to kreate & deploy one basik smart kontract on Ethereum.
  • Interact wit oda kontracts from Solidity – Hau to dey show one smart kontract from kontract wey dey exist and interact wit am.
  • Hau yu fit ridus yor kontract size - Hau yu fit ridus yor kontract size to kip am onda di limit and save on gas

Further reading

Know a community resource wey fit helped you? Edit this page and add it!

  • Building container
  • Run an Ethereum node
  • Nodes-as-a-savis

Shey dis artikol dey helep?