Wia to get ETH
Yu fit earn ETH, risiv am from yor peers, abi buy am from ekshanjis and apps.
Kurent ETH price (USD)
Sentralize ekshanj
Ekshanj na biznes wey go alow yu buy crypto wit normal money. Dem get pawa on top any ETH wey yu buy ontil yu send am go yor own wallet.
Mak yu earn ETH
Yu fit dey earn ETH if yu dey wok for DAOs abi kompany wey dey pay crypto, dey win bounties, dey find software bugs and more join.
Make yu risiv ETH from una peers
Wons yu don get one Ethereum akant, all yu nid do na make yu shia yor address to bigin dey send and to dey risiv ETH (and oda tokens) peer-to-peer.
Desentralize ekshanj (DEXs)
If yu wont more kontrol, buy ETH yusin . Wit one DEX yu fit trade digital asset wey yu nor go give pesin kontrol over yor funds for one sentralized kompany.
Wallets
Some wallet fit alow yu buy crypto wit yor debit/credit kard, even bank transfer abi Apple Pay. Im dipend on wia yu dey live.
Riwod for stake
If yu don get som ETH bifor, yu fit dey make more money as yu dey run one validator node join. Dem go pay yu for doing dis verifikashon wok for ETH.
All produt wey dem list for dis page nor get ofishia stamp, and don provide for infomashon pupose only. If yu wont add one produt abi provide feedbak for di policy make yu raise issue in GitHub. Make yu raise issue
Wich kountry you dey stay?
Ekshanj get some places yu nor fit sell crypto to. Dis na na list wey dey show savis wey dey operate for ish kountry. Endorsement nor dey inside hia - make yu do yor own research!
Enta yor kountry wey yu dey stay to see list of ekshanj wey yu fit yus
Disentralized ekshanjis (DEXs)
Wetin bi DEXs?
Disentralize ekshanj na open market for ETH and oda tokens. Dem dey konet buyers and sellers straight.
Insted make yu yus anoda pesin to safeguard funds on top yor transakshons, dem dey yus kode. De seller ETH go komot wen de payment don konfam. Na dis kain kode dem dey koll smart kontract. More on smart kontracts
Dis mean sey small geographical blokaj fit dey pass sentralize alternatives. If one person dey sell wetin yu wont and gri for one payment metod yu fit provide, yu fit kontinu.
Yu go nid wallet to yus one DEX.
Make yu get one walletMake yu buy wit oda crypto
Swap yor tokens for anoda pesin ETH. And vice versa.
Make yu kip yor ETH safe
Komunity posts on sekurity
Any singol organizashon nor dey Ethereum - im dey desentralize.
Dis mean sey yu nid to take di sekurity for yor money wella. Wit ETH, yu nor dey trust bank abi kompany to look afta yor assset, na yu dey do dat for yorsef.
Make yu kip yor ETH for yor own wallet
One of di ogbonge features for Ethereum bi sey yu go dey kontrol yor own asset as yu dey manaj yor own akant. Dis mean sey yu nor nid trust anoda person wit yor asset, and yu dey safe from anoda person wey want do wayo, goin luzin everytin wey yu get. Howeva, im also mean sey na yu dey in sharge for yor own sekurity.
Make yu shek out walletsYor ETH address
Wen yu download wallet, e go kreate publik ETH address for yu. Si hau dis go look like:
0x0125e2478d69eXaMpLe81766fef5c120d30fb53f
Eksampol: Nor kopy am
Rizin am like yu email address, but insted make yu risiv mail, yu go risiv ETH. If yu wan transfa ETH from ekshanj to yor wallet, yus yor address as di destinashon. Make sure say yu shek am wella bifor yu send am o!
Folow wallet instrushon
If yu luz kontrol of yor akant, yu go luz yor money. Yor wallet supose tell yu how to dey protect am. Make yu dey folow dem kiafuly - for plenti cases, nor one fit helep yu if yu nor fit enta yor akant.