Wetin bi staking?
Staking na like act of depositing 32 ETH to aktivate software. As pesin wey dey validate yu go dey responsibol for storing data, processing transakshons, and adding new to di blockchain join. Dis go kip Ethereum sikure for everybody and go earn yu new ETH in di process.
Why yu go stake yor ETH?
Make yu earn riwods
Dem give riwods for akshons wey helep di netwok rish . Yu go get riwods to run software wey batch transakshons wella into new bloks and sheks di work of oda pipol wey dey validate bikos dat na wetin dey kip di chain to dey run sikure.
Betta sekurity
Di netwok dey strong against attaks as dem dey stake more ETH, as im rikwaya more ETH to kontrol majority of di netwok. To bikom threat, yu go nid hold plenti pesin wey dey validate, wich mean yu go nid kontrol di majority of ETH in di system-dat one plenti!
More sustainabol
Pipol wey dey stake nor nid do hard work to dey kalkulate to helep sekure di netwok wey mean sey stakin nodes fit run on hardware wey good pass as dem dey yus littol enagi.
Hau to stake yor ETH
All dipend on hau mush yu wan stake. Yu go nid 32 ETH to aktivate yor own validator, but im dey posibol to stake less.
Shek di opshon bilow and go for di ones wey betta pass for yu, and for di netwok.
Home Staking
Wey dey impakt pass
Full kontrol
Full riwods
Trust nor dey
Home staking on Ethereum na di gold standard to dey stake. Im dey provide full partisipashon riwods, impruf di disentralizashon of di netwok, and neva nid to dey trust anyone else wit yor funds.
Doz wey dey konsida to dey stake from home suppose get some amount of ETH and one komputa wey konet to di intanet ~24/7. Some teknika knowlej dey helep, but tools wey dey izy to yus nau exist to helep make di process simpol.
Home stakers fit gada dem funds wit odas, abi go solo wit at least 32 ETH. Dem fit yus likwid staking token solushons to maintain access to DeFi.
To dey stake as one savis
Yor 32 ETH
Yor validator keys
Node operashon wey dem trust
If yu nor wont abi nor dey komfotabol to dey deal wit hardware but still wont stake yor 32 ETH, wey dem dey stake-as-one-savis opshons dey allow yu delegate di hard part while yu earn native block riwods.
Dis opshons dey always waka yu thru kreatin a set of validator kredenshials, as yu dey upload yor signing keys to dem, and dey deposit yor 32 ETH. Dis dey allow di savis to validate for yu.
Dis metod of staking rikwaya some level of trust in di provida. To limit kanta-party risk, di keys to witdraw yor ETH always dey wit yu.
Pooled stakin
Stake any amount
Make yu earn riwods
Make yu kip am simpol
Popula
Plenti gada solushons hapun to assist users wey nor get abi feel komfotabol to dey stake 32 ETH.
Plenti of dis opshon inklude wetin yu sabi as 'liquid staking' wey get one liquidity token wey reprisent yor ETH wey dem stake.
Likwid to dey stake dey make staking and unstaking as simpol as a token swap and dey enabol di yus of kapital in DeFi wey dem stake. Dis opshon also dey allow users to hold kustody of dem assets in dem own Ethereum .
Pooled staking nor bi native to di Ethereum netwok. Third parties dey build dis solushons, and dem karry dem own risks.
Sentralize ekshanj
Impakt wey smoll pass
Trust asumpshons wey high pass
Many sentralized ekshanjis provide staking savis if yu neva dey komfotabol to dey hold ETH for yor own wallet. Dem fit bi follbak to allow yu to earn some yield on yor ETH holdings wit minimal ovasite abi effort.
Di trade-off hia na dat sentralized providas dey konsolidate large pools of ETH to tun large numbas of pipol wey dey validate. Dis fit dey dangeros for di netwok and im users as im dey kreate large sentralized target and point of failure, wey dey make di netwok more vulnerabol to attak abi bugs.
If yu nor dey feel komfotabol to dey hold yor own , dat one dey okay. Dis opshons dey hia for yu. In di meantaim, make yu konsida to dey shek awa wallets page, wia yu go start to dey learn hau yu go fit take true ownaship ova yor monie. wen yu don ready, kom bak kon level up yor staking game to dey try one of di sef-kustody pooled staking savis wey dem day offer.
As yu fit don notis, plenti ways dey to join Ethereum staking. Dis path dey target difren kain of users and dem don get dem own unik and dey vary in terms of risks, riwods, and trust asumpshons. Some dey more disentralized, don battol am well and/abi risky pass odas. Wi go provide some informate on popular project for di space, but dey always do yor own researsh bifor yu send ETH anywia.
Komparison of staking opshons
One-size-fits-all solushon nor dey for staking, and ish one dey unik. For here wi go kompia some of di risks, riwods and rikwayament of di difren ways yu fit stake.
Home Staking
Riwods
- Boku riwods - get boku riwods direct from di protokol
- Riwods for proposing bloks, wey inklud unburnt transakshon fees, and dey attest wella to di state of di netwok
- Opshon to mint one likwid wey dey stake token against yor home node wey dem go yus in DeFi
Risks
- Yor ETH dey at stake
- Penaltis dey, wey kost ETH, for goin offline
- To dey slash (larger penalties and ejekshon from di netwok) for malishios behaviour
- To dey mint one likwid staking token go introduce smart kontract risk, but dis nor bi by forse
Rikwayament
- Yu suppose deposit 32 ETH
- Maintain hardwia wey dey run both Ethereum and as im konect to di intanet
- Di Staking Launchpad(opens in a new tab) go waka yu aroun di process and hardwia rikwayament
To dey stake as one savis
Riwods
- E dey always get full protokol riwods minus monthly fee for node operashons
- Dashboards dey often dey afailabol to track yor validator klient izy
Risks
- Same risks as solo staking plus kounta-party risk of savis provida
- Di yus of yor signing keys na to trust someone wey fit do bad
Rikwayament
- Deposit 32 ETH and generate yor keys wit assistans
- Store yor keys sikurely
- Wi don take kia of di rest, doh spesifik savis go dey difren
Pooled stakin
Riwods
- Pooled stakers accrue riwods difrent, as e dipend on wich metod of pooled staking dem shuse
- Many pooled staking savis dey offer one abi more wey reprisent yor ETH wey yu stake plus yor shia of di validator riwods
- Liquidity tokens fit dey yor own wallet, wey dem yus in and sell if yu deside to komot
Risks
- Risks nor bi di same dipending on di metod yu yus
- In general, risks karry body join kombinashon of kounta-party, and exekushon risk
Rikwayament
- ETH rikwayaments wey low pass, some projects rikwaya as littol as 0.01 ETH
- Make yu deposit diret from yor wallet to difren pooled staking platforms abi dey trade for one of di staking liquidity tokens
Kweshon wey Pipol dey Ask (FAQ)
Further reading
- Serenity Design Rationale - Vitalik Buterin
- Eth2 News - Ben Edgington
- Finalized no. 33, the Ethereum konsensus-layer (Jan 2022) - Danny Ryan
- Posts of pipol wey dey attest
- Beaconcha.in Edukashon Materials Wey Komunity Kontribut
- Kweshon wey pipol dey ask abou Ethereum Staking Launchpad
- Knowlege base for pipol wey dey stake Eth